Lantern-文本歌词

Lantern-文本歌词

发行日期:

Do your things make I do my own

No come here come dey block my road

And as a bad man me I face my goal

Me i no get time for bad mouth oo

See Dem be lil popa

If I post one pic Dem go go crop am

Anything I do people Dem go wan talk am

Everything Dem give ceazar I go come pack am cos I be godfather

I go still pack am

All the dollar for my way I go still pack am

If the shadi come my way I go still rock am

All the rose for the club we de still pop am cos them be lil popa

Them no fit top am all the gbedu I de drop them no fit top am

People wey no show me love them be improper fool

If them ask make you tell them say na me talk am

Omo wetin you sow na wetin you go reap

Look my back you go see my geez

If you bring wahala say na wetin you go see

Apologize before I take my leave

Them no de smoke my ** them no fit doam like me

And policeman no fit spoil my steeze

If I do good omo them go do me bad oo

If I do bad omo them go do good oo

If I talk truth them go say I too de yarn

If I no talk them go say KEZMAN bad oo

You de feel the lamba

Dem no fit off our lantern

Wetin God destined them no fit to stop am

Kezman I de giddem different patterns

Ehh say You de feel the lamba

Dem no fit to off our lantern

Wetin God destined them no fit to stop am

Kezman I de giddem different patterns

Yea yunno I came from the jungle

Where nobody really love you

But them want to de chop you dem want to Involve you for the thing wey you no do

When nobody to advise me I do it my way

Man steady de for highway

Enemies plenty my way so I runaway

Make them no go cut my pay

Where my people come de when the boy wan crase

Where ekaite come de when the boy no get that pay

Oya start to de dance am as the dJ de knack am

Oya show them your pattern na you be the matter

She say kezman I like am oya drop am you say

You de feel the lamba

Dem no fit off our lantern

Wetin God destined them no fit to stop am

Kezman I de giddem different patterns

Ehh say you de feel the lamba

Dem no fit to off our lantern

Wetin God destined them no fit to stop am

Kezman I de giddem different patterns pattern.